Description
Okeke say for di morning of Saturday 29 January 2022 im wife, 39 year old Chikaodi Okeke bin get small quarrel with one of dia neighbours, Mariam Adamu wey dey live di same compound with dem for No. 24 Chief Aleruchi Street, Rumuigbo Obio Akpor LGA of Rivers State, southern Nigeria.
"Dem live upstairs while we dey live downstairs. Her husband come meet me to settle say make I forget about di quarrel and I agree, go work. Later for afternoon time, dis Mariam with two of her colleagues for di yard, Miracle and Mummy Amanda gang up come start di matter afresh with my wife. Along di line, dis come result to fight between my wife and dem and pipo separate dem.
When I return for evening, di husband of Mariam come plead with me to leave di matter say on Sunday we go invite di landlord and settle di matter."
Kenneth Okeke say on Sunday 30 January 2022, after im wife finish cooking, she waka down dia street to go buy sachet water and mineral wey dem go take chop di food, naim dia neighbour, Mariam Adamu allegedly lay ambush for her along di Street near di store she go buy di tins, come pour her grinded pepper for body.
"She pour di grinded pepper on her for her eyes, nose evri wia. My wife fall down, den she remove dagger begin stab my wife up to four places come runaway.
Pipo for di Street see wetin happen come rush my wife for taxi go UPTH (University of Port Harcourt Teaching Hospital) but on di way, she die.'' e tok.
''Me I just escort visitor wey come visit us so I no bin dey around. As I come back naim pipo tell me say see wetin happen to your wife not up to 20 minutes. Na so I rush go UPTH go see say my wife don die. From dia to police to report and then to mortuary. Police deposit her for Military mortuary."
Oga Okeke say Mariam Adamu allegedly stab im wife for four places wey make im wife begin vomit blood until she die.
"She stab her for her hand, her breast and chest. Di stab for her breast naim touch her for heart wey make she begin vomit blood, dey bleed for mouth."
Kenneth Okeke add say two days after, police trace di suspect, Mariam Adamu to Auchi for Edo State, wia she run go and arrest her bring her back to Port Harcourt. E say dem also arrest di oda two ladies wey bin quarrel with im wife and now di case dey di State Criminal Investigation and Intelligence Department SCIID Port Harcourt.
Di acting tok tok pesin for Rivers State Police Command, DSP Grace Iringe-Koko confam to BBC Pidgin say dem don arrest three women wey dey suspected for di killing.
According to her di suspects dey di state Criminal Investigation and Intelligence Department (SCIID)as dem dey investigate.She say dem go charge di matter go court afta dem don conclude dia investigation.
Credibility: |
 |
 |
0 |
|
Leave a Comment